Nigeria secret police – Department of State Service (DSS) don deny reports say dem arrest di oga of Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) Ibrahim Magu.
But Nigeria corruption police boss get case to ansa, based on wetin BBC Pidgin find out.
According to EFCC wey be Nigeria corruption police, wetin happun na say dia oga honour “invitation by presidential panel to torchlight di work wey EFCC dey do”.
DSS don taya from pipo wey wan know weda dem get hand for oga Magu mata, according to press release wey di tok-tok pesin of Department of State Services Peter Afunanya send on Monday, 6 July.
Dis dey come afta breaking news comot earlier on di same say (DSS) don gbab oga of Nigeria corruption police Magu, dis na wetin we know about mata wey surround EFCC oga.
Source
- Original publisher
- BBC News Pidgin
- Original article
- Magu: DSS arrest of EFCC Acting Chairman no be true, but di corruption police boss get case to ansa – See wetin we know so far – BBC News Pidgin
- Original publication date
- Not recorded in the archive
- Republished on this domain
- 8 July 2020, by the previous operators of anticorruptiondigest.com
- Archived copy
- https://web.archive.org/web/20200716034859/https://anticorruptiondigest.com/2020/07/08/dss-arrest-of-efcc-acting-chairman-no-be-true-but-di-corruption-police-boss-get-case-to-ansa/ (captured 16 July 2020)
The text above is the work of the original publisher and is reproduced from the archived page. Rights holders can ask for it to be removed: see the archive notice.